Sunday 26 March 2017

LIFE OF A CORPER EP13

DID YOU MISS EP12

Episode 13
“My name is chinwe”
She dey smile. She know say her nyash Don
hook
me.
I gave her #200 say make she buy anything
wey
she want for break. She thank me comot.
She dey
ss3.
Another day she enter come meet. We gist
small.
I collect her number kon dey call her from
time
to time.

She dey frequent my office regularly sotay
other
students come dey gossip about us. And my
numerous girlfriends kon dey vex for me.
We come dey very close and she kon like me
die.
fast forward to around 1month later
One weekend, I call chinwe for night, we
come
dey talk about fun and s-x. I dey yarn sweet
s-x
talk dey tell am the kind things wey I fit do
for
bed and assure her say nobody fit do the tin
like
me. She just dey say “you are bad oh”. I
know
say the thing enter her head.
I kon invite her to come the Next day. She
argue
small, then she kon agree to come if chance
dey
o. Around 10pm that night. I receive text:
“Promise me I won’t be disappointed”
I laugh. I know say my whining touch her
brain.
I kon reply.
“It’s gonna be fun, I promise”
Meanwhile I Don book another girl (chioma)
to
visit me same tomorrow to avoid
disappointment.
If chinwe no come, chioma go come… all na
“CHI”.
Next day reach. Around 9:30 am, chinwe
flash
me, I call am.
“What’s up?”
“I’m fine”
“Are you still coming?”
“Is that all you care about?”
Naija girls like to use question answer
question.
Abegi, answer me.
“Sorry, how was your night?”
“Fine”
“Are still gonna come?”
“Yes”
“What time?”
“2 pm”
“Call me when you are about coming”
I relax, dey play jamz, dey sip alomo as I
dey
wait for 2′ O’clock…
As time Don dey reach 1pm. I baff, dress up,
kon
call my Guy (egar) for phone. Egar na my
homeboy, my tightest man and him too na
Corper
wey dey teach for another secondary school.
We
be birds of thesame bad feather.
“Homeboy, wetin dey happen?”
“I bam”
“You dey house?, I wan show your side
oh?”
“No. I follow My CDS group go visit one
motherless babies home for town”
“You keep key abi? I wan carry one chick
come
your crib”
“Yes. But You go wash my bedsheet oh”
We laff. Na joke. I know where him dey hide
key.
“No wahala”
I plan to control chinwe come egar house. I
get
my reasons. My neighbors bin Don start to
dey
gossip say I dey bring too many visitors.
Them even talk am for the last tenants
meeting
wey we do. I wan lay low small cuz them
they
respect me well well, I no wan fall my hand.
As, i reach egar house, I call chinwe, she tell
me
say she dey bathroom dey baff. Chai!!, I kon
imagine as she go use scrub her big nyash
with
sponge, maybe she get special big sponge
wey she
dey for her nyash sef.
She kon tell me say she go flash me if she
Don
ready to come.
I relax, go carry rice for egar kitchen dey eat
then kon use egar laptop dey watch music
videos.
Around 30 minutes later, she flash me. I call
her,
give am direction to egar house. She say
she Don
enter bus dey come.
I arrange room, carry air fresher spray
everywhere
kon Open curtains for fresh air.
She kon flash me later, I call back I call back ask her
where
she dey, she tell me, I rush go there but I no
see
her.
I call her back the number no dey go. I look
around everywhere and even waka go up
small but
I no see her.
Abi this girl wan carry her father play?. I
continue to call but the number no dey even
connect. Almost ten minutes Don pass.
All my anxiety Don turn to anger by then. I
vex
begin go back to egar house, I decide say I
no go
call chinwe again as she dey carry me play.
As I Don dey near egar house, she call me.
The
brain wey dey my head say “forget her” but
the
brain wey dey my p---k say “you dey mad?
You
Don forget her nyash? Comon accept her”
I like my p---k pass my head so I follow my
p---k.
Before I go decide, the phone cut. She call
again, I pick am sharpaly.
She say:
“Hello”
“Hello, where are you na?”
“I stopped at the wrong place, and my
battery
went off. I had to charge it at one shop”
“Ok. Where are you now?”
She mention one filling station, I enter keke
napep go pick her......

NEXT EPISODE

No comments:

Post a Comment

Trending on KOB